Published
5 years agoon
By
Adubianews
One French Actress, Corinne Masiero waka naked for di César Awards to ask goment make dem do more to support culture for di coronavirus pandemic.
Di 57 year old actress bin carry donkey costume take cover di bloody cloth she wear before she undress on stage as she suppose give award of di French version of di Oscars.
Na for more dan three months now dem don close down cinema halls for France and even sef, di awards bin happun under dey socially distanced rules.
She write “No culture, No future” for her naked chest and belle and “Give us our money back” for her bare back.
Oda actors don join too to complain ova di shutdown of cultural centres, as one pesin tok say e no make sense say im pikin fit enta mall, but no fit go cinema.
Last December, protests for Paris and oda places for di kontri bin happun against goment shutdown of culture centres sake of di pandemic.
Di protest bin get plenti actors, theatre directors, musicians, feem technicians and critics for dia.
Asiedu Nketia Uses NDC Thank You Tour to Collect Feedback on Government
Speaker Urges Executive to Grant Parliament Permanent Land
Finance Expert Warns Cocoa Reforms Could Worsen COCOBOD Debt
Jinapor Swears In New VRA Resettlement Trust Fund Board
Minority Demands Dismissal of COCOBOD CEO Over Cocoa Price Crisis
OSP Questions Baba Jamal Over Alleged Vote-Buying in Ayawaso East Primary
Police Arrest Woman Over Fire Incident at Alpha Hour Founder’s Church
NRSA: Commercial Tricycles Still Illegal Under Ghana’s Road Traffic Laws
NADMO Launches Rainy Season Safety Campaign in Fanteakwa South Markets