Published
5 years agoon
By
Adubianews
Nollywood actress, Ify Onwuemene, wey bin dey popular for her role for di sitcom ‘Everyday People’, don die of cancer.
Na her colleague Gloria Anozie-Young, announce di news of her death for her Facebook page.
For di post Madam Anozie-Young say di actress die on Tuesday May 25 afta she battle wit endometrial cancer.
“Ify don finally go to rest, today 25th May 2021. May her soul rest in perfect peace. Amen.” Na wetin Madam Anozie tok.
“Dem diagnose her with endometrial cancer. Dem remove her womb, but she don dey battle wit di sickness for many years now.” Na wetin she add put.
Di actress also tok about Ify battle wit di disease and di kain treatment wey she receive before she die.
For 2019, even after eight sessions of chemotherapy, di doctors tell her say she don reach stage 4. But we no dey sure if dem bin give her wrong diagnosis or dem being treat her wit di wrong chemo, because she bin still dey feel pains for her upper abdomen and her tummy dey bloated.
According to di actress she say Ify spend more than N10m, her fellow actors donate join plus oda Nigerians but in di end in no yield much.
Madam Anozie-Young say Ify family go release details of her burial arrangement
OSP Questions Baba Jamal Over Alleged Vote-Buying in Ayawaso East Primary
Police Arrest Woman Over Fire Incident at Alpha Hour Founder’s Church
NRSA: Commercial Tricycles Still Illegal Under Ghana’s Road Traffic Laws
NADMO Launches Rainy Season Safety Campaign in Fanteakwa South Markets
Adorye Demands Immediate Sack of Amansie Central DCE Over Galamsey Extortion Exposé
NDC Youth Petition Party to Fight Supreme Court Decision on Kpandai Seat
Minority Fights 24-Hour Economy Secretariat, Calls It Costly Bureaucracy
FGM Persists in Ghana Despite 30 Years of Ban — Cross-Border Practice Raises New Alarm
Defence Minister Delay Due to Parliamentary Recess – NDC’s Wonder Madilo Explains